Saturday

May 18th , 2024

FOLLOW US
pc

Mills Ahyia

10 months ago

MEEK MEEL AT JUBILEE HOUSE

featured img
News

10 months ago

MEEK MILL

Some Ghanians dey para well well as 'celebrated' American rapper, Meek Mill shoot some part of im music video for Jubilee House, wey be di Presidential Palace for di kontri.

Di video show as Meek Mill dey for different places for di Presidency, from di frontage to di main corridors, and inside di main conference hall as im dey rap.

Meek Mill bin visit di West African kontri and some of di major highlights of im time for Ghana include meeting wit Ghana President Nana Akufo Addo for Jubilee House.

Oda tins Meek Mill do for Ghana na one rough ride session of power bike.

Im bin also claim say dem tiff im phone from one event, im also fight some Jaguda pipo before im climb stage to perform.

Meanwhile one Ghanaian politician  Kofi Ofosu Nkansah don come out to defend di video shoot wey be like say dem film am for di Jubilee House.

Im tok say no be just "international celebrities" wey don get access to di presidential palace - wey show for part of Meek Mill's video.

"All di visitors di president receive for di hall wia di presidency lectern dey, get access to am and dey allowed to take pictures too. From Ghanaians to foreigners," Kofi Ofosu Nkansah post for Facebook.

Im also note say guests only get to take photos from di lecture wit di badge saying "Presidency", meanwhile President Nana Akufo-Addo use one lectern wit a badge saying "President".

Why Jubilee House important to Ghanaians

Jubilee House wey be di presidential Palace for Ghana for important to Ghanians sake of say na di residence of offie for di president.

Dem build Jubilee House for di site of one building wey dem construct and bin dey use for Administrative purpose by di British Gold Coast Goment.

Di former seat of power for Ghana na di Osu Castle.

President Nana Akufo Addo change di name from Flag Staff House to Jubilee House on 29 March, 2018

Meet the Author


PC
Mills Ahyia

Content writer

follow me

INTERSTING TOPICS


Connect and interact with amazing Authors in our twitter community