13 hours ago
Na inside Menkumedi Country, two presidential candidates, Kofi "Reset" and Kojo "Upgrade", dey contest for di top seat. Kofi dey campaign say the country dey need reset, while Kojo dey preach say upgrade be di way.
Kofi tell di people; "Our system don dey rotten, government people dey thief every day, people dema living hard well well. Our village need reset, no be upgrade we need now. We need new beginning, no be to patch patch old tins". Him emphasize say di economy, education, and healthcare systems all dey need total overhaul.
But Kojo Upgrade dey counter say, "We no need reset, we need upgrade. Our system get some good tins wey we fit build upon. We no fit throw away everything".
One day, Kofi Reset visit one village for campaign, wey e meet plenty people wey dey suffer, him ask de people, "My people. wetin dey happen?" de people say, "Kofi, our system don dey bad well well, food de cost, everything bad…we need reset".
Kofi say reply , "ok my people, I dey come to reset everything, no be upgrade". Di people happy well well, wey they talk say "Kofi, you be our hope, we go vote give you".
True true election happened, and Kofi win. Him become president, begin to reset system. Him sack corrupt officials, bring new people wey get sense. Economy begin grow, education improve, healthcare become better, people living don good.
People begin to see hope… people lives don make better, dem start to trust government again. Kofi become hero, dem dey call am " Kofi De-Reset".
-Lessons We Go Comot From System Reset-.
Failed nation dey need reset no be upgrade. We no fit upgrade wetin don spoil, we need reset dem because dem get plenty problems wey fit hinder progress.
Reset go help fix all problems, make government start fresh, and prioritize di people's needs. New leaders go come, wey go bring new ideas and vision.
-Di New Leaders wey go come, go help-:
1. Rebuild plenty Infrastructure: Build good roads, provide light, water, and hospitals.
2. Fight Corruption: Make sure leaders no dey chop government money nyafu nyafu again.
3. Secure di Country: Protect di people from thief people, kidnappas, and terrorist.
4. Grow di Economy: Create jobs, reduce hungry.
5. Restore Trust: Make government accountable, transparent, and responsive to di people dem.
Na so nation go rise again, and di people go enjoy better life if reset happen.
Total Comments: 0